cc

Funny Nigerian Pidgin Adages

Good Morning Readers. These are Strange Nigerian Pidgin Adages.. Try not to laugh too hard though 😃



1. Woman wey never see problem... Na im dey still
hold breast run.

2. Na for old age ashawo dey know the use of
pikin.

3. Small pikin wey dem carry for back no know say
the journey far.

4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later é go
hear am.

5. Na for afternoon dem dey find black goat.

6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled
egg.

7. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, SHE
GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND.

8. Pikin wey him mama back cross water, wey say
him march fish, wetin him mama go march?

9. Woman wey dey find pikin no dey wear pant
sleep.

10. Person wey don faint before no be stranger to
death.
11. Person wey chop belle full, no know wetin
hungry man dey see.

12. No be as woman dey close eye enjoy sex she
dey enjoy labour pains.

13. Yansh no get teeth but e dey cut poo.

14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody hail
am!! é go hail himself.

15.  EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.

17. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.

18. Na cricket tell him children say, No matter
how ground strong, Them no go sleep outside.

19. Pikin wey say him mama no fine they use style
call him papa blind man.

20. No be eye wey dem take chop eba dem take
dey share meat.

21. Person wey use Elephant set trap, na him know
wetin he wan Catch.

22. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open.

23. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS, BUT
STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW BOOK.

24. Dem no dey tell tortoise say race don start.

25. Meat wey you dey forbid, no use your teeth cut
am.😃👊

26. Before you see monkey, monkey don see you.

27. Thief wey jump fence enter house where owner
dey wait for am, no go jump again.

28. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am
say him sabi bury.

29. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey
kill am.

30. If e be like say everybody dey craze" na you
dey craze.

31. Dem no dey tell blind man say salt no dey for
food.
Previous
Next Post »